As I dey waka for night police stop me
As I greet them, dem say I Dey cocky
You get earring for ear? You be Fraud-y
GET DOWN from your motto, make we search you
As dey search my car dem come see lighter
Start calling me names, say na me be dealer
I try explain but they slap me twice (kpa kpa)
Say I be robber going to my next heist? CHAI
I no know wetin I go do o
They come dey tell me say I no dey go home
I come dey think say na the end of the road
Ah Babus Burger, Na like this you dey go
See Burna Boy e don Dey talk am o
Say if you no get money, no Dey try call police o
If not for all the people wey I know
Dem tell me say they rather shoot me than to let Me go
WELCOME TO LAGOS
Where Nepa no bring light… oh no no
LAGOS
Where Twitter Dey cause fight oyoyo
LAGOS
Where Jagaban getty might oh no
LAGOS
President e no Getty sight oh no
WELCOME TO LAGOS
Where Rape no be crime… no no
LAGOS
Where woman no getty mouth
LAGOS
Where policeman be the tout… o yo
LAGOS
Notin work, but I no fit shout